Segun Arinze
Hau e go bi
Segun Arinze (wey dem bon as Segun Padonou Aina for 1965) na Naija akto and singa.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Pipul dey holways fear abi doubt sumtin wey dem no sabi wel or wey be niu aria.
- Kanu, Okocha Nigeria’s greatest footballers – Segun Arinze. 28 June 2025, Punch Newspaper.
- Football na laif itsef. For everiday laif, na weda you dey trai skore goal or pesin dey trai block you mek you no skore. So e be lik say na atak and defens game di sem taim.
- Kanu, Okocha Nigeria’s greatest footballers – Segun. 28 June 2025, Punch Newspaper.
- No nid to dey kompete wit enibodi. Sky big wel-wel, ol bird fit flai insaid am. If I ci my felo aktos dey do wel, I dey rili hapi for dem fom my heart.
- My conflict with Emeka Ike ended naturally – Segun Arinze. 3 April 2025, The Nation Newspaper.
- I no lik mek dem holways giv me di sem kain rol. E dey kil akto wok.
- I dislike being typecast as an actor – Segun Arinze. 3 April 2025, The Nation Newspaper.