Jump to content

Simon Kolawole

From Wikitok

Simon Kolawole na Naija jonalist, columnist, poblik spika and media biznes man. E bi founder and oga for Cable Newspaper Limited, wey dey poblish TheCable.ng, one independent online newspaper for Naija.

  • Wi nid chenj di way wi dey manej govment moni for Naija. Wi dey spend moni without propa tinkin. For tu long, wi just dey tink hau to spend moni, wi no dey tink hau to mek moni, bikos oil moni dey show somtaims. Kontri for today no fit depend onli on oil moni and fri handout. Moni wey dey enta gatz strong, shwo and stedi.