Solomon Dalung
Hau e go bi

Solomon Selcap Dalung (wey dem bon for 26 September 1964) na Naija loya, pesin wey dey tich for skul, and politishan. E sav as Minista of Youth and Sports for Naija fom November 2015 rich May 2019.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Pipul today no fit fid diasef. Plenti pikin no dey go skul. Hospital dem don abandon am bikos pipul no dey fit waka go or get tritment. Wit dis kain wahala na wetin dey wori di votas.
- INTERVIEW: Hungry Nigerians will determine 2027 elections outcome — not coalition, says Dalung. The Cable, 19 April 2025.
- Enibodi wey dey pawa sopoz hia tru word, bikos na di foundation for ol rilijon bi dat.
- INTERVIEW: Why I left ruling APC – Solomon Dalung. 20 April 2022, Premium Newspaper.
- If anima dey hapi say butcher don kpai, e min say di naif folo kpai? If pipul wey gain fom wetin di pipul vote for dey jump go anoda side, e min say di pipul sef don chenj kamp?
- APC has become a gathering of sinners seeking forgivenes. 11 June 2025, The Guardian Newspaper.