Sule Lamido
Hau e go bi
Sule Lamido (wey dem bon for 30 August 1948) na one Naija politishan wey bi forma gofnor of Jigawa Stet from 2007 go rish 2015. Bifor e bi gofnor, Lamido don work as forin hafihas minista of Naija from 1999 go rish 2003. Na PDP (Pipo Demokratik Parti) memba e bi.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Wetin mek you turn mi to begga kom dey give me I beg manej am fud? Give me shans for me to fit yuz my own pawa tek find di wetin I wan chop. Wetin mek you wan finish mi patapata?
- Sule Lamido exclusive: Tinubu’ll be hard nut to crack in 2027 December 2024, The Sun (Nigeria)
- Wen two elifat dey fight, na di grass dey sofa. But, di grass no no enitin about wetin mek dem dey fight. Na we bi di grass wey no no enitin but dey sofa am.
- Sule Lamido exclusive: Tinubu’ll be hard nut to crack in 2027 December 2024, The Sun (Nigeria)
- For pesin to fit ondastand wetin dey hapun nowadays, di pesin go nid to luk back to wetin don hapun yesterday.
- Why Nigerian Politicians Must Fear Tinubu –Sule Lamido 8 November 2024, Daily Trust (Nigeria)
- Weyda you luk di mata go up abi you luk di mata go down, pipo go stil tok bad about me.
- Tinubu Dragging Us To Our Graves – Sule Lamido 26 November 2023, Daily Trust (Nigeria).
- I wan mek you ondastand dis tin: Human bein no dey eva dey ok with enitin. Dey jos bi like hanima wey dey tok "moo, moo", di more you give dem di more dey go dey cry dey wan more. E no dey possibu mek human bein tok sey wetin dem nid don dey ok. Evri human bein dey always dey luk for how e wan tek get pass di tins wey im done get bifor.
- INTERVIEW: Why I deserve praises, not condemnation for my services as Jigawa Governor – Sule Lamido 5 January 2016, Premium Time (Nigeria)