Taiwo Awoniyi
Hau e go bi

Taiwo Micheal Awoniyi (wey dem bon for 12 August 1997) na Naija futbola wey dey play as strika for Premier League club Nottingham Forest and Nigeria national team.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Futbol na wetin you like do. Injury na part of di game, and if e hapun say you no fit play, e go pain you sometimes. But you just gats wok had mek you fit rekova wel.
- 'We'll do everything in our power' - Awoniyi on battle for survival. BBC Sport, 14 April 2023.
- I bin dey luk forward to play against Liverpool bikos na dem sign me wen I be 18. E be emotional game for me. For my mind, I feel say na beta game for my team. We get plan to hold our shape wel, and for di end, we win. I hapi wel wel.
- Taiwo Awoniyi reacts to "emotional" winner vs Liverpool after being sold by Jurgen Klopp. mirror.co.uk, 22 October 2022.
- For me, if you fit biliv, no level wey you no fit rich. E fit look had for some pipul, but I biliv say, by God power, we fit rich final.
- INTERVIEW: I combed refuse bins to get shoes to wear for training – Nigerian striker Taiwo Awoniyi. Premium Times (Nigeria), 31 December 2017.