Taiwo Hassan
Hau e go bi
Taiwo Hassan (wey dem bon for 31 October 1959) na Naija pesin wey pipu sabi wel wel as Ogogo an e dey akt fim, dey produs fim, an dey dareto fim. Dem bon Taiwo Hassan for Ilaro, wẹy bi one town inside Ogun Stet.
Tins wey e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Rimemba, pesin wey don len how to troway blow go always bi bosar till e go kpai.
- Ògògó Taiwo Hassan spotted fighting with a street boy in his hometown. 22 June 2022, Tribune (Nigeria).
- Futbola an muzishan dey mek moni pass pipul wey dey akt fim. Na pipul wey dey akt fim dey kolet shikini moni pass.
- I’m going into farming -Taiwo Hassan. 14 August 2016,bThe Punch, (Nigeria)
- I no fit do wok wey no rili worth am. No bi evri job wey pesin see im dey do espeshali wen pesin don dey rish a saten levu in life.
- I’m going into farming -Taiwo Hassan. 14 August 2016 The Punch (Nigeria).
- If pesin dey do somtin an pipul no dey valu wetin dat pesin dey do, dis one min sey di pesin dey do notin bi dat. But if pipul wey dey around you dey praiz your wok, dis one dey ginga you to do more.
- Ogogo at 55: 'My saddest moment was when I was down with chronic ulcer'. 2014 Encomium (Nigeria).
- E no dey posibu mek pesin dey alive mek di pesin neva see one or two bad tins wey neva hapun to am. Wetin I like about mysef bi sey, If I don ovakom di problem wey dey wori me, I no dey see am as big tins again.
- Ogogo at 55: 'My saddest moment was when I was down with chronic ulcer'. 2014 Encomium (Nigeria).