Tee A
Hau e go bi
Babatunde Adewale (wey dem bon for December 19, 1974), wey pipul sabi as Tee A for stej, na Naija komedian, MC (Master of Ceremony), TV sho host and pesin wey dey produs content for media.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- E gud mek pesin olways trai do niu niu tins with im laif. Na wai i be stand-up komedian, TV produsa, event planna, and stil be first-klass MC. Enitaim wey pesin sopos fain way to repackage imself.
- I have no regrets as comedian, says Tee A. 14 August 2016, Punch Newspaper.
•Everibodi dey funny one taim or di ida. But wetin mek profeshonal komedian difren fom normal pesin be say e sabi stodi di pipul e dey woch am. E go sabi wetin to tok, wen to tok am, and hau to tek tok am.
- Why I’m not rich – TEE A. 28 July 2012, Vanguard Newspaper.
- Bifor bifor, komedi no dey bring beta moni. But as tins dey go nau, pipul don dey enjoi di tin wel wel.
- Why I’m not rich – TEE A. 28 July 2012, Vanguard Newspaper