Timaya
Hau e go bi

Inetimi Alfred Odon (wey dem bon for 15 August 1980), wey pipul sabi as Timaya, na Naija singa and songraita.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- You sopos dey hapi naturali first. But if you kom nid drink or eni oda tin to mek you hapi, e go tek ova dat your reel hapinez. Na so you go dey buy hapinez.
- Timaya opens up on struggle with drug addiction, says breaking free tough. 9 February 2024, Punch Newspaper.
- How pesin tek ci me no dey wori me at ol. I don pas dat levu. Wetin you tink or how you dey reason na lik fried egg and bread — e no koncern me.
- Only thing that changed about me is financial status – Timaya. 22 October 2024, The Nation Newspaper.
- If you dey wok for pesin or dem dey wok wit you, no do lik say you jos dey manej dem. Treat dem lik your famili bikos nobodi sabi wetin fit hapun tomorrow.
- Why I can't be Eedris Abdulkareems friend. December 2023, Tribune Newspaper.
- Di onli way wey you fit survive for dis ekonomi nau na if you dey kolet moni for dollars or foreign curenci. If you dey kolet forex and chenj am to naira, na dat one go mek you fit flex wel.
- Living in Nigeria becoming harder – Timaya laments. 23 October 2024, Daily Post Newspaper.