Tony Umez
Hau e go bi
Tony Umez na Naija aktor wey don akt ova 200 Naija fim. Tony Umez fit akt English or Yoruba fim wel wel. Na di 1998 fim Died Wretched: Buried in N2.3m Casket mek am popular.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- You ask pesin sey wich work e dey do, e go tell you sey im na politishan. Shey politishan na work? Politis na sarvis. But for dis pipo, na dem yuz am as work. Pipo dey tiff like sey tomoro no de an our lida no get eni trust for bodi.
- Tony Umez: Why I endorsed Peter Obi for 2023 presidency 22 November 2022, PM NEWS (Nigeria)
- I tink sey if you folo join bi pat of di problem, you no go fit join bi pat of di solushon at di sem time.
- Tony Umez: Why I endorsed Peter Obi for 2023 presidency 22 November 2022, PM NEWS (Nigeria)
- Di indostrie don mek me no sey life dey chenj, and no bi evri-tin wey shin-shin bi gold
- My pain, my joy as an actor – Tony Umez 23 October 2015, VANGUARD (Nigeria)
- Di koko bi sey, notin prepare you for eni-tin. But edukeshon dey veri impotat. Wen you don go skul, e min sey dey fit train you bi dat.
- My pain, my joy as an actor – Tony Umez 23 October 2015, VANGUARD (Nigeria)