Jump to content

Tunde Kelani

From Wikitok
Tunde_Kelani

Tunde Kelani (wey dem bon for 26 February 1946) wey pipo sabi wel wel as TK na Naija fim-meka. Tunde Kelani don dey mek fim an e don dey helep Naija kolsho for di pass forti years. Na Yoruba fims e like to do pass.

  • My fim dey sell bikos I dey respet pipo wey wan luk dem. Di levul wey pipo don put me an my nem dey impotat to me. No mata how bad e bi, I get my own standard. Bifor pipo go trust you, e dey tek time an you go don work for dem.
  • I bilif sey di sikrit to mek beta fim na wen pesin dey rid buk. Dat is di risin I dey tell young pipo to rid plenti buk wey dem fit rid. E dey pain me sey Naija pipo no like to rid.