Jump to content

Victor Anichebe

From Wikitok
Victor Anichebe (2011)

Victor Chinedu Anichebe (wey dem bon for 23 April 1988) na foma Naija futbola wey bin dey play as fowod.

  • I no see risin why we no fit join bodi [as playas] tek buy futbol klobs. I biliv say na anoda way to rili chenj tins. Insted of just dey hope for chenj, we fit be di chenj wey we want.
  • Sometimes, e go be like say na luck, bikos as young pleya, you gatz dey for di rait place at di rait time. You fit nid mek one first team pleya chop red kad or get injuri, den once you enta, na your hand e dey to use your chance wel.