Victor Osimhen
Hau e go bi

Victor James Osimhen (wey dem bon for 29 December 1998) na Naija futbola wey dey play as strika for Serie A club Napoli and Naija nashonal tim.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I no chenj di pipul wey dey araund mi bikos I no nid am. Notin don chenj. Na onli di kain klot wey I dey wie don chenj. Mai way stil bi di sem.
- ‘I only change clothes, not my circle’ – Osimhen. Daily Post Nigeria, 23 July 2023.
- Plenti pipul for di world biliv say Premier League na di best and strongest league. Bot nau, I dey play for one of di best leagues for di world, wey bi Italian Serie A.
- Mi and mai frend go dey go dustbin sait dey faind shoe. Wi go si Nike for left leg and Adidas for rait leg, wi go trai mach dem togeda. I grow for area wey no get moni at ol, and for mai strit, mai famili na one of di family wey pwo pas. Somtaims, awa landlod go kom dey distob mai papa and mai sistas bikos of haus rent. I go jos waka go one kona, bigin krai, dey beg God mek e help mi.
- Lille’s Victor Osimhen on his rise from a Lagos landfill, rejecting Arsenal and interest from the Premier League. The Independent, 15 April 2020.