Victor Osuagwu
Hau e go bi
Victor Osuagwu na Naija aktor wey don win di City People Movie Special Recognition Award wey hapun at di City People Entertainment Award. Victor Osuagwu na forma presidor of Legos Stet Shapta of di Actors Guild of Nigeria.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- God no mek marej for kwurel. Marej na for blesin an enjoi-met.
- My marriage…With Victor Osuagwu 6 April 2024, PUNCH (Nigeria)
- Shalenj go de but na how you tek handu am bi di koko. No mata wetin life bring kom, I dey tek am di wey Sport man dey tek shalenj.
- Why tipper conveyed me, wife on wedding day – Victor Osuagwu 24 February 2024, PUNCH (Nigeria).
- Wetin mek you a supa star na wetin dey inside you. No go dey kopi anoda pesin hadiya.
- Why tipper conveyed me, wife on wedding day – Victor Osuagwu 24 February 2024, PUNCH (Nigeria).
- So nobodi dey tek enibodi job; di hevun big rish for all di bird to fly.
- Why skitmakers can’t take me off business – Victor Osuagwu 5 August 2023, PREMIUM TIMES (Nigeria).
- Weyda you sabi abi you no sabi, you jos have to try your luck to see weyda you fit mek am for di indostrie.
- INTERVIEW: Zee World is taking over… our wives watch it all day long, says Victor Osuagwu 9 July 2017, THE CABLE (Nigeria).
- Na two mejo tins dey skata marej: wen trust no de an dia two no ondastand dia-sef.
- I could not sacrifice my wife for Nollywood babes – Victor Osuagwu August 2019, VANGUARD (Nigeria).