Victor Uwaifor
Hau e go bi
Victor Uwaifor MON (dey bon am 1 March 1941 an e kpai 28 August 2021) na Naija muzishan, raita, leshoral an pesin wey sabi yuz sand-sand mould somtin. Na Victor Uwaifor bi di fest Honorebu Komishonal for Arts, Kolshor an Tourism in Nigeria. E na di fest winna of gold disc in Afrika (Joromi) wey dem rilis in 1965. E still kolet oda gold disc in Guitar Boy, Arabade, Ekass series an Akwete music.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Wen you dey wota flawa, di flawa go grow. If you no wota am, di flawa go kpai. If you yuz your mind, di mind go dey grow. A man brain bi like balloon wey dey espan. E dey do me like sey at 80 years, I never yuz 80 pacent (80%) of my brain.
- Sir Victor Uwaifo… My journey to stardom, greatness 13 March 2021, GUARDIAN (Nigeria).
- If you no no your past an you no no your preset, you no fit win di fushon.
- VICTOR UWAIFO speaks passionately about his collabo with 2Face on Legend Reborn album 2014, ENCOMIUM (Nigeria)
- Evri-bodi get skill an talent, wetin we nid to do na to diskova dem.
- Exclusive Sir Victor Uwaifo Interview: 'I am the greatest Nigerian musician 11 July 2014, THE NET (Nigeria)
- Di problem wey nowaday Naija muzishan get bi sey dem no wan len muzik onda pesin wey sabi pass dem. Evri-bodi wan mek am shap-shap. No bi so tins dey work .You no fit bi graduate if you no go skul. You no fit sabi rid an rait if you no sabi ABC to Z. You no fit sabi sabi muzik if you no no muzik d,r,m,f,s,l,t,d!
- With a computer a dog can be a musician now: Victor Uwaifo's parting shot 28 August 2021, PM NEWS (Nigeria).
- Na three tins dey kontrol life: di mental, di fisikal, an spirishual. For fisikal, I dey do exercises. For spirishual, I dey sit for one korna dey tink wel an muzik sef dey helep me join. For metal, I dey rid plenti buk an dey stodi.
- I almost died of electrocution on stage in 1969 – Sir Victor Uwaifo 4 April 2021, PUNCH (Nigeria).
- Muzik na sirious bizness. Sey you opun mouth sing no mek you a muzishan, dey you dey play futbol for road no mek you futbola an sey you sabi argue mata no mek you lorya. You fit sabi spik English no mek you jornalis. You sabi drive motor no mek you mekanik. Pesin go nid to train wel wel to fit bikom profeshonal.
- I almost died of electrocution on stage in 1969 – Sir Victor Uwaifo 4 April 2021, PUNCH (Nigeria).