Vincent Enyeama
Hau e go bi

Vincent Enyeama (wey dem bon for 29 August 1982) na bifor bifor Naija futbola wey play as go-kipa. Evun though e no too tol like oda go-kipa, pipul stil see am as one of di best go-kipa wey Afrika don eva get for futbol histri.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I don put wetin don hapun for bak as I stil dey train, dey hope say I go fit kom bak strong. Go-kipa fit play futbol for long, and I biliv sey I stil get plenti tins to giv. But na me go fest stop if I no sey I no fit giv my best again. For now, I go just dey train for haus dey hope for beta tin.
- Vincent Enyeama: Where did it go wrong?. goal.com, 26 April 2020.
- I biliv sey we sopoz sopot our playas, jinja dem, stand for dem, hype dem. I notis one tin—wen I dey play for France, Naija press pipo no too dey hype me like dat. See Mbappé, e be Mbappé todey bikos dem hype am wel wel.
- I’m Not Interested In Returning to Super Eagles – Enyeama. GoalBall Live, 6 October 2019
- I no fit tell Naija no, na di Koko be dat. If Naija kol me todey sey, ‘Vincent, we get go-kipa wahala, we nid you,’ I go kom. I no fit sey no.
- Vincent Enyeama says if Nigeria calls him to return to super eagles he will oblige. 36NG, 14 September 2019.
- I no fit do am without God. E no easi to be di playa wey don play di hiyest nomba of game for Naija. Pesin go nid fly omore than 100 times to fit do am, but God protet me all through.
- Vincent Enyeama : Five Reasons Why I Succeeded In My Career. Opera News Nigeria.