Wilfred Chikpa Anagbe
Hau e go bi
Wilfred Chikpa Anagbe (wey dem bon for 2 April 1965) na Naija big bishop for Katolik Choch, wey dey serve as bishop for Diocese of Makurdi.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Awa wok as God ministas na to giv pipul hope. Di pain big and e go tek time bifor e hil; without faith wi no fit pliz God, and dis faith gatz show for akshon. As lidas, di chalenj wi dey face min say wi gatz tek ril steps of faith to hil and bring bak pipul hope. Wi must get strong mind rimuv di shame from awa brodas and sistas wey dia digniti and raits don dey abuse by pipul wey wan distroi dem just bikos dem get difrent bilif.