Wilfred Ndidi
Hau e go bi

Onyinye Wilfred Ndidi (wey dem bon for 16 December 1996) na Nigeria futbola wey dey play as defensive midfielder for EFL Championship club Leicester City and Nigeria national team. Ndidi sabi wel wel for defence.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Na somtin wey I pesonali wan do—mek I expand myself and learn new tins. Instead mek I just sidon for house afta trainin, I go DMU go do my klas.
- Leicester City's Ndidi completes diploma in Business and Management. Goal.com, 27 August 2022.
- I no dey see myself as enibodi else, na just myself I be. Weda pipul tok say I dey play like Kanté or say e beta pas me, I no dey listen to dem. My own na to just play bol and kontiniu to improv. Right now, everitin dey wok wel—di team dey do di smol smol tins well, and we dey try muv fowod from dia. I just like di winning spirit wey di team get pas di way I play or wetin I wan achiv.
- Leicester City’s Wilfred Ndidi: ‘The other players were scared and couldn’t cope’. The Guardian, 8 April 2017.
- My papa dey woch futbol for televishon, but e no wan mek I play bol. E be soja, but e no wan mek I folow e way. E just wan mek I go skul.
- Ndidi: My father — a soldier — never wanted me to play football. TheCable, 31 March 2017.