Wole Soyinka
Hau e go bi

Akinwande Oluwole Soyinka (wey dem bon for 13 July 1934) na Naija playwright, poet, novelist, essayist and pro-democracy activist. For 1986, e bikom di fest African wey win Nobel Prize for Literature.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I tok say: “Tiger no dey shout say e be tiger, e dey akt.” Minin say, tiger no go stand for bush dey tok “I bi tiger.” Wen yu waka pas wia tiger don waka bifor, yu go si bone of animal wey e don chop, den yu go sabi say tiger don dey dia.
- Janheinz Jahn (trans. Oliver Coburn and Ursula Lehrburger) A History of Neo-African Literature (London: Faber, 1968) pp. 265-6.
- Eni man wey kip kwayet wen wikednes dey hapun, dat man don olredi kpai smol smol inside.
- The Man Died (New York: Harper & Row, 1972) p. 13.
- River-mussel get onli one wota wey e fit liv; tortoise get onli one shel wey dey kova am; human soul get onli one world wey e belong. If dat world skata, wia wi go run hide?
- Death and the King's Horseman (1975); cited from Six Plays (London: Methuen, 1984) p. 189.