Yakubu Ayegbeni
Hau e go bi

Yakubu Ayegbeni (wey dem bon for 22 November 1982), wey pipul sabi as Yakubu, na bifor bifor Nigeria futbola wey play as striker. E guy name na "The Yak".
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]- I stil remain one of di best strikers wey Africa don produs, no mata say some players don score pas 100 goals. Make una no forget say dem play for some of di big big clubs for England.
- I remain one of Africa’s best strikers –Yakubu. Punch Newspapers, 16 October 2021.
- I no go ever apologise. Why I go do am? I don score plenti goals for Nigeria too. I don sacrifice plenti tins for di kontri. Enibodi apologise to me bifor? No be say I gree mis dat goal. I rili wan score, but e no just hapun.
- Aiyegbeni: I Won’t Apologise For 2010 World Cup Goal Miss. Complete Sports, 29 January 2021.
- I rimemba say wen I kom bak Nigeria, I waka go kitchen for downstairs, I see my kuk, e dey pres phone. I ask am, ‘wetin you dey do?’ E kom explain say no be game, say na betin, futbol. Everibodi for Nigeria like futbol, dem like do tins like dat, you sabi.
- Yakubu Ayegbeni: The importance of finding the right brand to promote. Insider Sport, 13 October 2020.