Yul Edochie
Hau e go bi
Yul Chibuike Daniel Edochie (wey dem bon for 7 January 1982), wey pipul sabi wella as Yul Edochie, na Naija aktor and politishan.
Wetin e tok
[chenj-am | chenj-am for orijin]•Biliv me, pipul wey lov you pas di ones wey no lik you. But na di ones wey no lik you dey mek nois pas. No mind dia noise. No let enibodi bring you down. Dey raise your head dey go.
- Marriage Crisis: ‘Don’t let anybody pull you down’ — Yul Edochie to Emeka Ike. 11 September 2025, Premium Times Newspaper.
- No let ol dos fain-fain lov pisho wey hosband and waif dey post for intanet deciv you. If dem tel you di kain gbege wey dey dia hauz, you go run. Evun di pipul wey dey intavew your famili tek di mata dey mek moni, dia own hauz sef no beta.
- Marriage Crisis: ‘Don’t let anybody pull you down’ — Yul Edochie to Emeka Ike. 11 11 September 2025, Premium Times Newspaper.
- Marej no be by fors or sey pesin must die put. If you ci sey di marej no dey wok again, komot wit respet. You no nid wound each oda. And if you waka komot and you ci anoda pesin wey you wan mari, go mari am. If dat one stil no wok, komot. If you jam anoda pesin, mari again. If dat one stil no wok, komot. You fit mari 50 times if na so e go tek mek you hapi.
- One can marry 50 times’ – Yul Edochie. 8 June 2024, Daily Post Newspaper.